My WAEC candidate, how you dey? Physics dey give you headache? Formulas full everywhere, calculations dey confuse you? No panic.
Top Educators and Physics Teachers don gather the 2026 WAEC Physics likely questions with full answers inside video lessons. Dem break everything down so even if Physics na your enemy before, you go start dey understand
WetIN You Go Gain From This Video Lesson
1. Likely Questions: Dem don analyze past 10 years WAEC questions + current syllabus. The questions wey dey repeat and wey WAEC love to set, na dem dey teach you.
2. Step-by-Step Answers: No just answer. Teacher go show you how to derive formula, how to substitute, how to avoid silly mistakes wey dey cost marks.
3. Simple English: Dem no go dey speak grammar. “If mass be 5kg, g na 10m/s²…” Teacher go explain am like say na your senior dey teach you for hostel.
4. Topics Weh Hot For 2026:
– Mechanics: Motion, Force, Work Energy Power
– Heat Energy & Gas Laws
– Waves: Sound + Light, Refraction
– Electricity: Current, Ohm’s Law, Meter Bridge
– Nuclear Physics + Electronics – WAEC dey set am more now
– Practical Physics tips so you no fail lab
Why This Video Lesson Go Help You Pass Well
1. You go see am: Physics na practical subject. For video, teacher go draw diagram, do calculation on board, show you shortcuts. Better pass text-only PDF.
2. Save Time: Instead of you dey read 5 textbooks, dem don compress everything wey WAEC dey ask into one package.
3. Exam Techniques: Dem go teach you how to manage time, how to answer theory vs objective, which topics to focus if time no dey.
4. Access Anytime: Watch with your phone, anytime, anywhere. Rewind the part wey hard you till e enter brain.
Who Make The Video?
Na Top Educators and Physics Teachers with years of WAEC experience. Dem don mark WAEC scripts before, so dem know how WAEC want you to present your answers. No half-baked explanation.
Brainiac Tutors
AllCBTs by Allschoolabs
SHARE WITH YOUR FRIEND